ATTENTION, ARSENAL FANS DEM!!!


Attention all Arsenal fans, old o, young o, pretty... worwor... Eh, no vex I Know say we no worgly sha!!! 

Season don finish and we did a good job by consistently supporting our team in good and bad times.

Still, we carry 3rd for League come go win FA Cup for the second consecutive time!

I no say bele dey totori we plenty and we go get plenti tinz wey we go like yan about dis season wey just finish so and wetin we go like see for de next season wey we wan enta so.

So, to cap up the podcast for dis season I go like make passionate Arsenal fans dem send me voice message. You fit use your phone record am, make e clear sha... talk your mind about this season wey just finish and wetin you go like see next season as e take consine Arsenal so. Keep am short and simple o, like 2 minutes. If Pidgin hard you, you fit talk am for English but I go yab you sha!

Record your message send am as audio file attachment to tonydoe78@gmail.com. No forget mention your name and twitter handle join.

I don dey follow some potential partners dem yan and hopefully tinz go solidify next season as we go dey give out arsenal jersey and souvenirs!

Make I take time thank all of una wey log on to the blog come use una hard earned MB download de podcast join.

God go bless una well well!

Up Gunners!!! 

Comments

Popular posts from this blog

OAPs ARE NOT EVEN MUSIC FANS...

SO YOU WANT TO BE ON RADIO? SITES & RESOURCES

THE BEST SELECTION: COVER VERSIONS (S01E10)